Defination Of Beauty - OrukaTv.com

News, Gossip, Entertainment, Relationship and more...

STAY WITH US

Home Top Ad

Thursday, 26 February 2015

Defination Of Beauty


The game plan be say, no matter how a girl ugly reach for this World wey she come so, e get one particular boy/man wey dey die for her. So all these fine girls wey dey do anyhow and wey dey dey saucy, make una go break egusi. Because you fine, you think say all the men for this World go dey follow you shey? You never see anything. Highest, as you fine reach, na maximum of five (5) boyfriends and maga you fit get......any addition, na inside boiling water you go see yourself.

Beauty without good character, na one chance na....abi una no know. You dey Lagos dey form fine girl, people wey dey Enugu state no dey see your face sam sam...dem no know if you dey exist sef, so why you dey do nyanga? Better go house, go help your Mama cook Ogbono soup.Una think say babes wey no fine reach una no get boyfriends or husbands abi? See una head! Instead to dey use your beauty dey create positive change and touch lives for we society, you dey use am dey intimidate weak weak people wey no know their worth. A beautiful woman, na woman wey God create, weda she fine or not, but wey get good attitude and she dey respect people.....that's the true definition of Beauty....no be all these self-acclaim beautiful girls wey their face dey like Shawarma.

Chukwuemeka Ekenaka

8 comments:

  1. This comment has been removed by a blog administrator.

    ReplyDelete
  2. Dis your writeup touches d eyes and tickles d obi!....well said!...but why u feel say na all beautiful babes no get charater???...na individual tin oo...ugly gals get dr own fr body too....!...abi ur gf ugly??? N u won giv her hope*winkz

    ReplyDelete
  3. nor mind them,,,cause of say dem fine like mami-water dem don lost all their character finish..

    ReplyDelete
  4. If a girl is beautiful and always acts beautiful,
    Avoid Her !


    If a guy is handsome and always acts fine boy, Avoid Him !

    If a girl is rich and also acts rich,
    Go for Her !

    If a guy is rich and always acts Big Man, babe, No miss am.

    Beauty without coins na yawa...

    Afterall, Beauty is in the eyes of the BEER HOLDER. Lolzz

    ReplyDelete
  5. That fine chikala no gree for u? Sorry o, try d ugly one, she no go do shakara. But na true u yan shall, b4 fine girl go do shakara finish, ugly girls don marry d better husband remain leftovers.

    ReplyDelete
  6. D irony of d whole tin z dat wen u go 2 d mkt where food itemz ar sold, majority of d buyerz ar men and wen u visit a buker where already-made food ar sold, majority of d buyerz ar ladyz.

    D world don somersault.

    ReplyDelete
  7. A beautiful woman, na woman wey God create, weda she fine or not, but wey get good attitude and she dey respect people.....that's the true definition of Beauty....no be all these self-acclaim beautiful girls wey their face dey like Shawarma.

    Hahahahahahaha......Bro ur mama born u wella. Ur message z az pure az a virgin gurl. No addition no subtraction!

    ReplyDelete
  8. my babe is de most urly girl in ma skul but i love her, to my view she is de most beautiful i ever seen. If u re nt happy wit dis post pls take a bike to de end of de street and hug transformer, I will pay de bike man.

    ReplyDelete