How Some Nigerian Guys Behave On The Internet - OrukaTv.com

News, Gossip, Entertainment, Relationship and more...

STAY WITH US

Home Top Ad

Friday, 20 February 2015

How Some Nigerian Guys Behave On The Internet


Guys, make una know say that babe una dey razzle get plenty other guys wey dey toast her. So you think say as the babe no too fine, na only you dey toast am shey? See, no matter how any babe worwor reach for this world so, e get person wey dey straff am, so no just reason say na only you dey on board.

How you go just add babe now now, come dey yarn anyhow like "I love your a##", "I love your b0obs", "I want to be your best friend". Like seriously, who does that? Na wa oo, so you wan force yourself to be her bestfriend unto say you wan use that skills to gradually be her boyfriemd? My brother, that method no dey work again. So una suppose change tactics.

Say your friend dey chat raw and e dey work for am, no mean say e go work for you....how you even ma dey sure say that your friend dey talk true? You just add babe, and the only thing wey you fit talk na to ask for sex chat and request for nude.....she never even reply, you don send your pen!s picture. So na so you wan carry get babe? Olodo naim you be.

Always get am at the back of your mind, say that babe wey you dey try impress get plenty admirers wey dey toast am. Therefore, you suppose reinvent your tactics. Be unique, free, and funny....and gradual. She never ask one thing, you don begin download your family history....how God take save you from so so accident unto say you dey find sympathy. O boy, I taya for some guys oo. What of those guys wey dey stay Yankee. Chai, dem go tell babes wey dem just add now now oo, say dem dey abroad to huzzle get money, say dem go come back come marry the babe, say dem don show the babe pictures to their mother and their mother approve the babe. Nna ehn, see tactics na. Some babes dey fall mugu oo, walahi.Na rush rush dey spoil everything. I say na rush rush dey spoil every. Some rush rush fit work oo, but in majority situation, e no dey work. Guys want make everything be sharp sharp, the wan toast babe today make she agree tomorrow. All these toasting things dey take time, even weeks or months sef. So you just have to be patient, relax and chill. No go dey use skills wey your friends dey use, say your friends girlfriends dey send them nude pictures no mean say you go just demand nude pictures from babe wey no even know you sef. Haba, why you dey behave like that? Just be yourself and flow gradually, and no dey go tell female strangers say you wan be their best friend - which kind style be that. Na bestfriend or na boyfriend you want? E go better.

This post is written in Nigerian pidgin English.

By Chukwuemeka Ekenaka

7 comments:

  1. ust check d guys doing does shit u will dat it TECHNO dat caused it by making cheap fone dat browsers..d 1 hate more is d ''Thanks 4 accepting my request'' welcome 2 my world...I love u send me ur number...all dis on d gals wall...I always ask dem wht inbox is ment 4

    ReplyDelete
  2. as in ehn dis talk make sense wella,i don delete sm guys bc na only love dey der brain,dey no fit chat Intelligently if no b 2 spin gals.dey no no say gals dey fall 4 brains, show a gal ur brainy nd versatile nd watch her fall 4 u gradually

    ReplyDelete
  3. I have many of them in my list, mannerless and senseless

    ReplyDelete
  4. Some babes don't even know their values . Sending a guy nude pix won't make him love you . Learn to respect ur self be friendly with guy's but never send nude pix to any guy no matter how you love him . That's bullshit to me.

    ReplyDelete
  5. but how possible is it for a girl to send her nude picture to a guy she met on Facebook ??? I seriously doubt the possibility .......... Even a guy u call your fiance may never demand for your nude pix and even if my fiance demand for my nude pix, i doubt if I will .......... seriously I can't trust anyone with my nude pix. Do u know what that means?? Any guy with ur nude pix has the master key to ur destruction anytime... ladies pls lets take this love or flirt things easy we are always @ the losing end. Apart from our body being the temple of God, our body is also our pride and should be guarded properly.

    ReplyDelete
  6. meeeeennnn!!!!!! the thing tire me oooo!!! some guys no get shame at alll... and they no get respect even small... person go just see woman for facebook now now, and sharp sharp him go want be her boyfrnd. haba!!!! na only una waka come????

    ReplyDelete
  7. This comment has been removed by the author.

    ReplyDelete