Naija Girls And Yankee Love - OrukaTv.com

News, Gossip, Entertainment, Relationship and more...

STAY WITH US

Home Top Ad

Monday, 23 February 2015

Naija Girls And Yankee Love

That thing wey dey make some Naija babes reason guys wey dey abroad dey taya me. When dey meet any guy for Facebook or other social networks wey dey Yankee, their body go dey sweet them. Them go just bone we guys wey dey huzzle for Naija. No be mouth, some of us get opportunity to travel abroad, but we wan remain for we Country make am.

You go meet guy for Facebook, because him dey abroad, you go fashy dat fresh graduate because him never make am. You think say life for abroad easy? No be my brother tell me say e better make you earn 200k per month for Naija, than to earn 3,000 dollars per month abroad, because for abroad so, you must pay for everything wey you dey use. The money wey dem dey pay for bills for abroad, no be here. No be for Naija wey you fit dodge tax, dodge water and nepa bills. That guy wey you meet for facebook come dey die for am, get family members wey him dey send money to. After you don wait three years, you come hear say the guy don enter inside prison or him don marry one babe over there, na that time you go dey look for that fresh graduate...When you come hear say that fresh graduate don get better job and him dey engage, you go come open your mouth dey shout men are wicked. Make thunder slap you there! Those guys wey dey abroad no better pass us, and no be because una gbadu Yankee guys go make us huzzle to travel abroad. If una like make una dey wait for guys wey una meet for social networks na....dama if una fashy us, the wise ones go accept us.

by Chukwuemeka Ekenaka

13 comments:

  1. life is all abt choice, wat abt u guys dat forgets d girls dat started wit u from d scratch, all bcoz u tink deh allno more in ur levels, or not as beautiful or intelligent as ur new catch, or u met a white lady abroad. U guys are indeed wicked, hrt breakers, u tout us d game, nd now u re angry bcoz we play it more dan u can eva do. If u can't deal wit dat, forget it coz u can't stop it.

    ReplyDelete
  2. Abiiiiii ooooooooo A very elongated,excellence,unprecedented in Pidgin write up.I salute you naija village/sex life. Pls help us to tell them those Naija Ladies outthere

    ReplyDelete
  3. all that glitters is not gold.

    ReplyDelete
  4. This is wot I call "d slave mentality" D whites av made us believe nothing good can ever come out of Africa, dat we Africans can never b responsible 4 anytin of value... It pains me dat in dis Era of education, we still believe in dat daft and Goatic mentality... Dats y u'll see a typical Nigerian guy, leaving school bcos he wants 2 travel "Out", some will sell dier property 2raise so much money, instead of dem 2start a business wit it, dey will end up being duped just bcos dey want 2 travel out... A typical Nigerian girl will b in an invicible relationship 4 years wit a guy abroad, chasing all other suitable guys away.... Chai.... "THE SLAVES WHO LOVES THIER CHAINS" if only dey can travel out and see dier beloved boyfriend carrying people's bag at d airport 4 $50, washing dishes at resturants, sweeping d streets... Av u ever seen a white man wash dishes here in Naija? No mater how poor dey ar, dey never bend so low... THE SLAVES WHO LOVE DIER CHAINS" u'll see Nigerians being embarrased at dier stupid embassies... D moment u travel out, even doh u went 4a programme, people believes u're a millionaire.... THE SLAVES WHO LOVE THIER CHAINS I am proud of my Nigerian Guys hussling here in Nigeria... I am very proud of u... Together we shall build this Nation.... I refuse 2 share in d mentality of a slave

    ReplyDelete
  5. e no gud 2 de lay al ur eggs in 1 basket bcus 9ja guyz 2 dey do gals anyhw dem no de de proud of us if na lie, make any gal ask anyboy 4 facebuk say him get babe,him go say e don break up .so no b sum lady's fault sha.our guyz no de proud of us.

    ReplyDelete
  6. abroad or no abroad if u no handle ur woman well maybe she no be ur own..take heart bro.

    ReplyDelete
  7. true talk.. But most 9ja guys are lazy,especially when they know that they have a girl that's ready to hustle with them, they just become so lazy all of a sudden.

    ReplyDelete
  8. person wey dey earn 200k monthly for Naija no better person wey dey earn £3000 monthly for yankee o, perish that thought. Of course, abroad you pay taxes on more things, but you get to see to those things especially water, light, and healthcare. but in Naija you fit even dey suffer with your money if care is not taken

    ReplyDelete
  9. Nigeria has the potential of bein one of the best countries we just need the right leadership I have family members abroad and My brother no be beans oo. it is Not easy, they pay water bill, tv bill as in to own a tv and watch local channels like our AIT you pay, there is a bill for everything am surprised dem no get bill for breathing.. My naija brothers una dey buy tv like say tomorrow no dey, dey do jobs here and there How many times have u been confronted for Not paying bills and etc..?? the best we can do for our country is get education abroad, gain more knowledge and exposure then come back to implement it in our home

    ReplyDelete
  10. Some of us get the opportunity to travel to anywhere but we chose to stay ooo.. Secondly, anywhere wey u like make u come from, I dey play my wing well...

    ReplyDelete
  11. Rubbish post must u tag girls on it? if ur babe dumb u bcos of yankee guy must u come and generize it?park well abeg

    ReplyDelete
  12. Vice versa now... U no say na Yankee babes som guys dey chase 4 Fb? Dem go dey toast dem mama mate.... Ther's a 20 somtin yr old married a 60+ German woman... Even im family follow them take photo.... I take my eye see everytin

    ReplyDelete
  13. I once pretended to be in Russia, I know how them babes begin... ... Damn! You're right!

    ReplyDelete